Some Jealous Family Members Of Ginimbi Accuse Him Of Kuromba

Some Jealous Family Members Of Ginimbi Accuse Him Of Kuromba. In some shocking audios posted on social media family members of the Kadungure clan make statement concerning the passing of Ginimbi and how he lived his life. Many suggest that he used super natural powers to gain his wealth. Some are even talking about buring his mansion as they claim there are goblins Zvikwambo in the mansion, Watch the video below.

Popular Zimbabwean socialite and millionaire, Ginimbi Genius Kadungure die for one serious accident on Sunday morning wey happun for Borrowdale, Harare, di kontri capital.

Michelle Moana Amuli wey be popular Zimbabwe model dey among three odas wey also die for di accident. Report say Moana na one of di passengers wey dey inside Genius "Ginimbi" Kadungure Roll Royce Wraith wey crash come catch fire along Borrowdale Road and kill everybody wey dey inside.

According to police report Ginimbi, Moana and two odas bin dey celebrate Moana 26th birthday before dis happun.

According to tori pipo iHarere News, di two oda passengers for di Rolls Royce Wraith na Limumba Karim - one Malawian national wey dey wanted for im home kontri for fraud and one woman from Mozambique named only as 'Elisha'.
Michelle Amuli wey dem popularly know as Moana na Zimbabwe socialite, fitness enthusiast and model.

Dem born Moana on 6th November 1994 and she be 26 years old before her death on Sunday 8th November, 2020 and she once tok say na for ghetto dem born her. Moana 'Mimie' na video vixen and don feature for one video by award-winning musician Jah Prayzah. She become popular afta she play Jah Prayzah love interest for im video Munyaradzi for May 2020.

She bin tok for one interview say: "I no go through auditions but Jah Prayazah crew look for me, I dey sure say dem know me through my IG video clips wia I post and showcase my talent."

She don also appear for oda videos by Takura Zvemoyo, Enzo-Mwenje and Freeman - Miridzo.

Apart from say Moana na fitness coach, Yogi, and brand influencer, she also dey play basketball.
For October 12, Moana post one video for Her instagram wey she flaunt her diamond-encrusted engagement ring say she don dey "officially off di streets"

But as somebody wey like to keep her private life private, Moana no reveal di identity of di man wey win her heart and engage her.
Eye Witness account of how di accident take happun
Reports say dem don discharge Lucky Chikwanda, di pesin wen dem claim to be di driver of di blue Honda fit motor wey Ginimbi Roll Royce Wraith crash with.

Lucky Chikwanda nephew narrate wetin happun for phone give one tori pesin, Denford Ngadziore wey dey work with Zimeye, dat na one Zimbabwe local news station.

Danford say Ginimbi dey drive at top speed, and im bin wan try overtake three motor wey dey in front, then all of a sudden one car just stop for middle of road, na so Ginimbi Rolls Royce go jam di blue Honda and catch fire immediately.
Denford say im Uncle, wey e name na already 'Lucky' dey lucky to dey alive.

E add say, e don hear rumour wey say di accident get political hand inside , but dat rumour na lie as im Uncle no dey any political party.

Ginimbi bin dey come from Dreams Night Club togeda wit im friends, Karim, Elisha, and Moana wey dis accident happun and all of dem die on di spot.

  • Share: